Songtexte.com Drucklogo

My Head My Belle Songtext
von M.I. Abaga

My Head My Belle Songtext

My belle oh, my head oh
My belle oh, my head oh
My belle oh, my head oh
My belle oh, my head oh

Mommy don′t cry
I'ma make sure say we no die
I′ma go hustle, lemme go try
Hunger hook man for neck, shey na bow tie?
Whatever it takes, me I no shy
If na heaven food dey, make we go sky
E better than make I sit down make I no try
I go even buy ticket make we both fly


Mama, yeah
If it mean say, make I turn slave Kunta Kinte
Anything just to make clean pay
You never see food chop since Wednesday
Make I wash car, sell gala and I shine shoe
Shey na work, anything I no mind do
I go do better work, even times two
'Cause it's not easy, it′s not easy, it′s not easy

My belle oh, my head oh
My belle oh, my head oh
My belle oh, my head oh
My belle oh, my head oh

Charly, no vex
Anything for your boys make we go flex
No work make we do, so no cheques
Ah, we sef wan rock Rolex
Do something for your boys, we're loyal
You be king, you be chief, you be royal
Alaye, you go scatter dem total
International star, no be local, ayy, ah

If we get work wey go bring better food make we dey chop
No be road we for stand, we for dey shop
If for say things connect like good network
If for say school fees dey, we for dey class
You sef know say Warri no dey carry last
But as things dey now we no fit chop grass
At all, at all, na hin bad pass


My belle oh, my head oh
My belle oh, my head oh
My belle oh, my head oh
My belle oh, my head oh

Naija people just surviving
Okada riding, police bribing
Pastor preaching, pay your tithin′
School fees paying, food providing
Impure water, no electric
So much traffic, see the life is hectic
Sewage leaking, there's air pollution
Rats are everywhere, no solution

Road with potholes, people dying
All the bastards politician′s lying
University, degree pursin'
Fuel scarcity, people queuing
Black market, petrol impurity
Arm robbery, there′s no security
Fuel prices, it's Niger Delta
Religious crisis, then no shelter (hey, hey, hey, hey)

Oga stop there!
Abi you never see road block here?
Na we be the police, search and stop here
If you wan pass son, gotta drop here
You no dey see gun, abi you no well?
If you form actor, you go go cell
See behind counter, no be hotel
You go do three night before you go bail, ah, ah

But if you wan move, you sef know wetin you suppose do
Do am quick-quick make I no expose you
Nyem something make I hold or I'll hold you
Hey! Seargent Collins, make you come check
Search am quick, search him bag and him pocket
Any exhibit wey we come get
Then alarm go blow all na trumpet, all na trumpet

My belle oh, my head oh
My belle oh, my head oh
My belle oh, my head oh
My belle oh, my head oh

My belle oh, my head oh
My belle oh, my head oh
My belle oh, my head oh
My belle oh, my head oh

Songtext kommentieren

Log dich ein um einen Eintrag zu schreiben.
Schreibe den ersten Kommentar!

Quiz
In welcher Jury sitzt Dieter Bohlen?

Fans

»My Head My Belle« gefällt bisher niemandem.